Lawyer for Menzgold talk say make the customer admit say e take investment risk wey e lose out after e invest over GH₵5m.

SAM
0


The lawyer for Menzgold talk "say you just take investment risk and lose out after you invest more than GH₵5 million"

Lawyer Kwame Akuffo, during the cross-examination, ask the witness, wey be civil engineer, say e no be risk e take as e invest plenty inside business like Menzgold?

The civil engineer, Stephen Attippoe, talk say e depend on the things wey Nana Appiah Mensah, Menzgold, and Brew Marketing Consult tell am, but later e come realize say the business of the accused people no get license.

Stephen Attipoe invest GH₵5.2 million inside three months and e get GH₵502,000 for one time.

E get seven different trading agreements with Menzgold Company Limited and e buy gold for seven transactions for Brew Marketing Consult office wey dey for Spintex. E explain say the Menzgold trading agreements dem produce and sign for Tema Branch Office of Menzgold, as the company procedure talk.

Mr. Attipoe tell court say the documents wey e collect from Menzgold Company Limited for each of the seven transactions, include the gold trading agreements, purchase of gold receipts, the gold vaults service receipts, and receipts for the commissions wey dem ask am to pay for each transaction.

Dem charge Nana Appiah Mensah and two other people.

The Attorney General don file 39 counts of fresh criminal charges for High Court against Nana Appiah Mensah, wey dem dey call NAM 1, wey be the CEO of Menzgold Ghana Company Limited.

Dis one happun afta e make pass 36 appearances without trial over three years, 11 months for Circuit Court, as dem dey wait for advice from the Attorney-General.

For di new charge sheet wey dem file for High Court, NAM 1, together wit Menzgold Ghana Company Limited (MGCL) and Brew Marketing Consult Ghana Limited, dem don charge dem wit plenty tins. 

Some of di charges include say dem sell gold without license, operate deposit-taking institution without license, dey entice people to invest and defraud dem wit false pretences, fraudulent breach of trust and money laundering.

According to di facts wey dey before court, di accused pipo, under false pretence, collect over GH¢1.68 billion from dia customers and till now, dem neva recover di money.

Investments wey Stephen Attipoe make.

On June 1, 2018, Mr Attipoe buy five kilograms of 22-carat pure gold from Brew Marketing Consult, and for dis amount of gold, e pay GH¢1million to Brew Marketing Consult. Plus, dem make am pay GH¢64,500 cash wey be 6.4% commission wey e no fit collect back.

On June 5, 2018, e buy another 5 kilograms of 22-carat pure gold from Brew Marketing Consult and for dis amount of gold, e again pay one million cedis to Brew Marketing Consult. E still pay the commission of 6.4% on top of dis amount.

On June 13, 2018, e invest for di third time wit di accused pipo and e buy another five kilograms of 22-carat pure gold from Brew Marketing Consult. E pay one million for dis amount and still pay di commission of GH¢64,500.

On June 14, 2018, e buy gold for di fourth time. Dis time, e buy three kilograms of 22-carat gold from Brew Marketing Consult. E pay GH¢600,000 for dis amount of gold. E still pay GH¢80,700 cash as commission wey e no fit collect back.

On June 27, 2018, e do e fifth transaction wit di accused pipo. E buy another three kilograms of 22-carat plus gold from Brew Marketing Consult. E pay GH600,000 for dis amount of gold. E still pay GH¢80,700 cash as commission wey e no fit collect back.

On July 23, 2018, when e make e sixth investment, e buy another four kilograms of 22-carat gold from Brew Marketing Consult. E pay GH¢800,000 for dis amount of gold. E still pay GH¢50,600 cash as commission wey e no fit collect back.

On July 27, 2018, as e make e seventh investment, e buy one kilogram of 22-carat gold from Brew Marketing Consult. E pay GH¢200,000 for dis amount of gold. E still pay GH¢12,900 cash as commission wey e no fit collect back.

In total, e invest GH¢5,200,000 for di company gold vault market. E buy twenty-six kilograms of gold. E also pay GH¢335,400 as non-refundable commission.

Wetin Stephen Attipoe collect from Menzgold?

For July 2018, Menzgold give Mr. Attipoe GH¢504,000 as en monthly 12% interest for di twenty-six kilograms of gold wey he invest.

For September 2018, Menzgold give Mr. Attipoe ECOBANK cheque wey worth GH¢240,000 as en interest for only ten kilograms of gold.

As Mr. Attipoe carry the cheque go ECOBANK for Tema Main branch, dem no gree pay the money. Dem dishonour the cheque.



Post a Comment

0 Comments
Post a Comment (0)
Our website uses cookies to enhance your experience. Learn More
Ok, Go it!